For Naija, any which way na way, but unto sey we no wan loss, we kukuma carry waka sidan for house. Who waka epp? - Stefn Sylvester Anaytonwu
WHICH WAY?
E don tey wey I de pray make Jah show me the way;
But e be like say Jah compass no de behave.
I no go shock sef if boys don move am enter Agege.
Test the thing sharply hail am that other way.
In Nigeria everybody even pikin has to know the way,
Everybody wey you meet go talk say all way na way.

I enter bank say make I withdraw my change;
I jam queue wey take small thing pass my eye gauge,
As I de think my life for queue de wait my turn,
Two men like that just enter sharply collect their coins;
People hala but the sharp guys no even budge,
The important thing is that their pockets have bulged.
Toh, all of us know say all way na way.

My editor guy carry im lappy de go work;
I been tell am the night before say im dreads no work,
My guy ignore me and to his utter shock,
SARS stop am the next day ask am im handwork;
As baba shape mouth to begin to de talk,
Them slap am punch am tell am to shut up.
I for say make I continue the tori;
But I no fit talk,
Cos my guy dey SARS cell for Ikoyi just de cool off.

The other day I de stroll for Ago-Palace way,
I see our gallant police officer for one shop wey near highway;
Him de share change with one Tinubu boy like that
Whose mouth is exactly like the skunk wey him de usually take.
What can I say if not hei God Chineke m eh,

Which way Nigeria which way?
The right way is the wrong way
While the wrong way might probably lead to the road that leads to what looks like the right way?
I am confused as to which way to take.

Toh what am I saying,
I don almost forget say for Nigeria all way na way.
Make I kuku enter left with the hopes say na aim be the correct way.

About Writer:


Upp. G is a poet, photographer, writer and a polymath.

Enjoyed reading? Commenting is now easy. 
I introduced Facebook Comment feature. Please help my blog grow by leaving a comment and sharing with friends. Thank you!